NIMC registration portal: How to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN

NIMC registration portal: how to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN

NIMC registration portal: How to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN

MTN, Glo, Airtel, 9mobile di major mobile phone networks for Nigeria don release easy and quick steps for subscribers to use register dia National Identification Number NIN for dia phone.

Dis dey following di order wey Nigerian Communication Commission give for everybody wey dey use SIM cards to validate dia registration by linking dia NIN.

NCC give two weeks deadline till 30 December for telecommunication operators to block all customers wey no gree register dia SIM cards wit di National Identification Numbers.

You fit check your National Identification Number NIN just by using USSD code on your phone.

Di National Identity Management Commission ask Nigerians to use dial *346# to retrieve dia NIN number.

Di USSD code dey available for customers wey dey use MTN, Airtel, 9mobile and Glo network.

NIMC registration portal: how to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN
Wetin we call dis foto,

National ID card

Wetin you go need register your NIN

Wen you wan register your NIN to your mobile number, you go likely need:

  • Mobile Number
  • Full Name
  • NIN Number (wey you fit check using *346#)
  • Email Address
  • Date of birth.

Visit di Customer NIN Capture https://mtnonline.com/nin/

You go see di form wia you go fill in your full name.

Then put your MTN Mobile Number

Type your NIN

Fill in your email address

Then click on di button wia dem write 'SUBMIT'

NIMC registration portal: how to link your MTN, Glo, Airtel, 9mobile sim with NIN

Mobile short code for MTN

You fit also dial *785#

E go ask you to imput di 11 digits National Identification Number, then send. E go tell you say e don dey successful.

Send UpdateNIN (put space) NIN (put space) First name (put space) and Last Name to 109

  • Di steps na to dial *121*1#
  • Imput your 11 digit National Identification Number
  • After you go receive text message saying e dey successful
  • Visit di website https://9mobile.com.ng/nin
  • Click on di green space wia dem write 'verify and link your NIN now'
  • Link your NIN to your 9mobile Number
  • Visit http://www.9mobile.com.ng/nin Or you can dial *200*8#. Or call customer service 200 for instructions if finding it difficult.
  • You can visit a 9mobile service centre close to you.
  • Enta your mobile number and fill di requirements .

Di Federal Ministry of Communications and Digital Economy don order all network providers to cancel di N20 charge for di retrieval of di NIN wit immediate effect.

He say dis na to make di process dey easier and affordable.

Dis one mean say all Nigeria fit check dia NIN using di *346# for free.


Reference :

https://www.bbc.com/pidgin/tori-55392137

Comments

Popular Posts